Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 1:44 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

44 Filip na from Betsaida, wey bi Andru and Pita home-town.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 1:44
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Filip and Bartolomew; Tomas; Matiu, wey bi tax kollector; James, wey bi Afaeus pikin and Taddaeus.


“E nor go betta for Korazin and Betsaida pipol! If to sey di mirakles wey dem do among una happen for Tyre and Sidon, dem for don turn from dia sin kom meet God, kon karry ashes put for head and wear tear-tear klot,


Plus Andru, Filip, Bartolomew, Matiu, Tomas, James wey bi Afaeus pikin, Taddaeus, Simon wey dem dey koll Zealot (pesin wey dey fight for en kountry),


So Jesus tell en disciples make dem enter boat cross go di oda side for Betsaida, den e send di pipol go house.


Wen dem rish Betsaida, dem bring one man wey nor dey si kom meet Jesus make e tosh am.


“Korazin and Betsaida pipol, curse dey una head! Bikos if to sey na for Tyre and Sidon dem for do di mirakles wey dem do for una town, di pipol der for don turn from sin kom meet God since, dem for don sidan, wear sack-klot and put ashes for dia head kon dey beg God make E forgive dem.


Simon (wey bi Pita) and en broda Andru and James, John, Filip, Bartolomew


Wen di apostles kom back, dem tell Jesus evritin wey dem don do. Den Jesus take only dem follow body go Betsaida.


Wen day break, Jesus kon plan to go Galilee. Wen e si Filip, e tell am, “Make yu follow mi.”


Wen Filip si Netanel, e tell am, “Wi don si di pesin wey Moses and di profets rite about for dia book sey, ‘En name na Jesus, wey en home-town bi Nazaret and na Josef pikin e bi.’ ”


Netanel kon sey, “Betta tin go fit kom out from Nazaret?” Filip ansa am, “Make yu kom si.”


Netanel ask am, “How yu take know mi.” Jesus ansa, “Before Filip koll yu wen yu dey under di tree, I don si yu.”


Dem meet Filip wey kom from Betsaida for Galilee kon tell am, “Oga God, wi go like to si Jesus.”


Filip tell Andru, den dem kon go tell Jesus.


Wen Jesus look up, e si plenty pipol dey kom meet am. Den e ask Filip, “Na where wi go fit si bread buy wey all dis pipol go chop?”


Filip ansa, “Even if wi buy bread wey rish two hundred silva koins and if dem share am small-small, e nor go rish evribody chop.”


Wen dem enter Jerusalem, dem kon go di room for upstair where dem dey stay. Pita and John; James and Andru; Filip and Tomas; Bartolomew and Matiu; James wey bi Afaeus pikin, Simon wey dem dey koll Zealot and Judas wey bi James pikin, na all of dem gada for der.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ