“My Papa put evritin for my hand. Nobody know di pikin, but na only en Papa know am. Nobody know di Papa, but na only di pikin and anybody wey di pikin choose to show.
dey sey, “Yu wey sey yu go distroy di temple kon build am back for three days, make yu save yorsef! If yu really bi God Pikin, make yu kom down from di cross!”
Wen di sojas oga and di pipol wey dey guide Jesus Christ si di eartkweke and wetin happen, dem fear well-well kon sey, “True-true dis man na God Pikin.”
and e tell Jesus, “If yu really bi God pikin, jump go down, bikos dem rite for God word sey, “ ‘God go kommand en angels make dem do evritin for yu and dem go katch yu make yor leg nor nak stone.’ ”
But dis tins wey dem rite so, na make una for bilive sey na Jesus bi di Christ and naim bi Man Pikin and if una bilive am, una go get life thru en name.
But pesin wey dey like to sin, na devil pikin, bikos devil dey sin from di biginnin. Na dis one make God Pikin kom dis world, so dat e go skata all di work wey devil dey do.
Wi know sey God Pikin don kom and e don give us sense to know di trut about God. And wi dey inside en Pikin Jesus Christ. Na-im bi di real God and na-im bi di life wey nor go end.
Pesin wey nor dey follow wetin Christ tish, but dey find oda yeye tishas, nor know God. But pesin wey dey obey dis tishing, get both di Papa and en Pikin.
“Make yu rite di tins wey I won tell yu naw, go give di angel for di church wey dey Tiatira: ‘Dis message na from God Pikin wey en eye red like fire wey dey burn well-well and en legs bi like bronze wey dem polish: