God Spirit go dey with am. E go gi-am di Spirit wey dey give wisdom; di Spirit wey dey give knowledge and di Spirit wey dey give good undastandin. E go still gi-am di Spirit wey dey give pawa and di Spirit wey go make am rule well. E go gi-am di Spirit wey go make am fear God and do wetin E wont.