23 John kon sey, “Na mi bi dat vois wey dey shaut inside wildaness sey, ‘Make una make di road wey pipol go pass go meet God strait well-well’, as Profet Isaya tok before.”
Na dis John Profet Isaya tok about sey, “One pesin dey shaut inside wildaness sey, ‘Make una make God road strait.’ ”
One pesin dey shaut inside wildaness sey, “Make una prepare Oga God way for am, make una make en road strait.”
Again, dem ask am, “Who yu bi sef? Make yu tell us, so dat wi go know wetin to tell di pipol wey send us. Who yu sey yu bi?”
(Na di Farisee pipol send dis pipol go meet John).
Unasef go fit bear witness sey, I tok sey I nor bi di Christ, but God send mi kom, before Christ go kom.