Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 1:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 Di Jew oga dem send priests and Levi pipol make dem go ask John sey, “Who yu bi sef?”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 1:19
27 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E kom bear witness for di lite, make evribody for fit get di shance to bilive wetin God tok thru en word.


Di Jew oga dem gada round Jesus, kon ask am, “How long yu go make us dey wait? If na yu bi di Christ, make yu tell us.”


Di Jew oga dem kon pick stone again, won kon stone am.


and from der, many Jew pipol kon salot Mary and Marta, bikos of dia broda wey die.)


Di Jew oga dem kon ask am, “As yu dey do all dis tins, na wish sign yu go show us make wi for fit bilive yu?”


Den di Jew oga dem tell am, “Na forty-six years dem take build dis Temple and yu dey sey yu go fit build am for three days?”


Den di Jew oga dem kon tell di man wey dey waka naw sey, “Today na Sabat, yu nor suppose to karry yor mat dey waka.”


Di man kon go tell di Jew oga dem sey, “Na Jesus bi di pesin wey make mi well.”


Bikos Jesus dey do all dis tins for Sabat Day, di Jew oga dem kon dey make trobol with am.


Bikos of dis, di Jew oga dem kon dey try to kill-am, bikos dem sey e dey break di Sabat law and e dey koll God en papa, like sey en and God na mate.


Den di Jew pipol bigin vex and komplain about Jesus, bikos e tok sey, “Na mi bi di bread wey kom down from heaven.”


Den di Jew pipol wey dey vex with Jesus kon bigin dey argue with one anoda dey sey, “How dis man go give us en flesh make wi chop?”


Afta, Jesus kon travel go evriwhere for Galilee. Den e komot for Judea, bikos di Jew oga dem won kill-am.


Di Jew oga dem kon dey ask pipol, “Where e dey?”


Di Jew oga dem sopraiz and dem kon dey sey, “How e take know dis tins wey e dey tish so, as e bi sey e nor go skool at-all?”


So di Jew oga dem kon dey ask, “Abi e won go kill ensef? As e dey tok sey, ‘Where I dey go, una nor go fit kom der?’ ”


So di pipol kon sey, “E bi like sey yu bi Samaria pesin and demon dey inside yu.”


Den di pipol sey, “Eehen! Wi don know naw sey demon dey inside yu. Abraham and di profets don die, but yu dey tell us sey, ‘Anybody wey follow wetin I dey tish nor go die.’


Den di pipol ask am, “Yu neva old rish fifty years and yu sey yu don si Abraham?”


But as John dey finish en work, e kon tok many times sey, ‘Wetin una tink sey I bi? Nor bi mi bi di Mezaya. Make una si, somebody dey kom afta mi. I nor rish to remove shoe from en leg!’


Paul kon tell dem, “John baptize pipol wey turn from sin kom meet God with wota kon tell dem make dem bilive di pesin wey go kom afta am and na dat pesin, bi Jesus Christ.”


As una dey do as di priest sey make una do, make una dey kareful about bad diziz. Make una obey all di kommand wey I don give una.


Na di message wey wi hear from am, naim wi dey tell una so: Na God bi lite and darkness nor dey inside am at-all.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ