“My Papa put evritin for my hand. Nobody know di pikin, but na only en Papa know am. Nobody know di Papa, but na only di pikin and anybody wey di pikin choose to show.
God wise well-well, so E nor let pipol for dis world know am with di wisdom wey dem get. Instead, E save only di pipol wey bilive di foolish message wey wi dey prish.
But wi (wey bi Christian), na only one God wi get and naim bi awa Papa. Na-im kreate evritin and wi dey live for am. Na Jesus Christ bi awa only Oga God. Na-im make evritin and na thru am wi get life.
Bikos God kreate evritin for heaven and eart thru en pikin; both Fisical and spiritual tins; weda dem get pawa or dey rule for difren-difren place; God kreate dem thru am and E kreate dem for am.
Make una si di kind love wey awa God get for us. And naw, pipol dey koll us God shidren and true-true, na God shidren wi bi. Di world nor know us, bikos dem nor know am.