My God, make Yu remember wetin Edom pipol do wen dem kon distroy and karry Jerusalem pipol komot from dia own land. Dem dey shaut, “Make una skata Jerusalem rish groun! Skata di town rish groun!”
God go divide Egypt pipol sea; E go wave en hand pass Eufrates River kon send one strong breeze, den E go turn am to seven small river wey don dry kon make pipol dey waka pass with ordinary leg.
Edom pipol wey dey stay for Uz land, make una dey laf naw. Make una know sey dis judgement cup go rish where una dey too; una go drink from am until di drink don shark una and una go kon naked.
Dis na di vishon wey God give Obadaya about Edom pipol. God send en savant kom di nashons and dem hear di message wey God give dem sey: “Make una ready! Make una gada una sojas go fight Edom pipol!”
Just as una distroy Lebanon, na so too dem go distroy una finish. Una kill all di animals wey dey der, but naw, animals go worry and kill una. Dis tin go happen, bikos of di pipol wey una kill and di wahala wey una kause for dis world.
I go bring dem kom back from Egypt and Assyria kon make dem stay dia own kountry again. I go still make dem stay for Gilead and Lebanon and dia pipol go full di whole land.