9 Na God make di Bear, Orion, di Pleiades and di sky for sout.
God make two big lite: di one wey big pass go shine for day time and di small one go shine for nite. God make di stars too.
Heavy rain dey kom from sout, while strong kold breeze dey kom from nort.
From God house for heaven, E dey send rain kom wota di mountins, so dat di seed for di eart go grow.
Yu build yor palis kon put am on-top di kloud where rain from dey kom. Yu turn di kloud to yor shariot kon dey ride am on-top di wind.
E dey kount and koll di stars by dia names.
But e get one Pesin wey make di stars, Pleiades and Orion. E turn darkness to lite kon turn day to nite. E koll wota from sea kon pour am put for di eart. En name na God.
From der wi kon rish Rhegium and afta one day, one kind breeze from sout kon start to dey blow and di sekond day, wi kon rish Puteoli.