Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 9:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 Na only en make di heavens kon waka on-top wave for sea.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 9:8
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen di world just start, na God kreate di heaven and di eart.


Di gods for oda towns nor mean anytin, but na God make di heavens.


Wen E breath, di sky dey klear. Na en hand E take distroy di big snake.


God spread di sky for nort kon hang di eart for empty space.


yu fit help God bring di sky kom out kon make am strong like iron wey dem polish?


I tell am sey, ‘Na here yu go rish and yu nor go pass der! Na here yor pawaful wave go for stop.’


Yu don rish where di wota wey dey full di sea dey? Abi yu don waka for under sea before?


Na with di word wey God tok, E take kreate di heavens. E breath en word and all di stars for heaven, appear.


Yu waka on-top di sea go diliver yor pipol kon strol pass di great river, but nobody fit si yor footstep bikos e nor show at-all.


Na di Pesin wey sidan for di throne, make am. Di One wey dey on-top di eart and high pass di sky. Pipol for groun, small like ants for en eye. E dey stresh di sky like curtain; like tent where pipol dey stay.


God wey kreate heaven kon stresh am out, wey make di eart and evribody wey dey inside, di Pesin wey give life to di pipol wey dey di eart and spirit to doz wey dey waka inside sey,


Dis na wetin God wey save una, di Pesin wey form una for una mama belle dey tok: “Na mi bi God wey kreate evritin. Na only mi stresh di heavens kom out kon design di eart as I wont.


Una don forget God wey make una; di Pesin wey stresh heaven kon make di eart foundashon? Why una dey always fear pipol wey dey opress una; doz wey ready to distroy una? But naw, una nor go fear dem again.


So Israel pipol make una tell di oda nashons sey: ‘Nor bi doz gods make di heavens and di eart. So dem go disappear komot from di eart and heavens.’


Na God make di eart with en pawa; na-im wisdom and undastandin E take kreate di heavens and eart.


God make di eart with en pawa; na en wisdom E take kreate di world kon spread di heavens with en sense.


Dis na God message about Israel. Na God kreate di sky and di eart kon give life to man. God sey,


Wen dem don padol di kenu go rish about three or for mile, dem si Jesus dey waka on-top di wota dey kom near dem. Fear kon katch dem well-well.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ