28 my trobols go still kom back again; den I go know sey Yu dey hold mi bikos of di bad tins wey I do.
Yu dey look to si weda I go sin, so dat Yu nor go forgive mi.
“Naw, bikos na Yu dey kount my steps, Yu nor go kount my sins again.
“But e nor get wetin I go tok give yu, wey fit help mi and even if I kwayet, e nor go remove my pains.
Wen I tink about wetin dey happen to mi, my body go dey shake, bikos of fear.
And naw, evritin wey I dey fear, don dey happen to mi so o-o.
But God dey find rizin make E for dey ponish mi like sey I bi en enemy.
Yu nor fit just forgive mi my sins? Yu nor fit just sorry for all di bad tins wey I do? I go soon die and wen Yu dey look for mi, I go don go.”
“Yes, all dis tins wey yu dey tok so, I don hear dem before. But how pesin go fit take win kase with God?
I dey shake bikos I dey fear Yu and yor kommandments and rules dey make mi sopraiz.
If to sey Yu, my God won kount all di sins wey pesin kommit, den na who go fit stand before Yu?
Make una nor use di Oga una God name take make yeye, bikos I go ponish anybody wey do like dat.