21 I know kare again, life don taya mi, bikos I know sey I nor do any bad tin.
E get one man wey dem dey koll Job, e dey stay for Uz land and e dey do wetin God wont. E dey serve God with klean belle and e nor dey do bad tins.
Even doh Yu know sey I nor dey guilty, e nor get who fit save mi from yor hand.
Even my friends dey laf mi naw; dem dey laf, but I know sey I nor do any bad tin. I bilive sey God go ansa my prayers.
I don dey ready to komplain gi-am, bikos I know sey I dey rite.
‘I nor dey guilty; I neva do any bad tin or kommit sin.
I wish sey God go distroy mi! I wish sey E go just kill mi with en hand.
Yu nor fit just forgive mi my sins? Yu nor fit just sorry for all di bad tins wey I do? I go soon die and wen Yu dey look for mi, I go don go.”
Even if I nor do any bad tin, di only tin wey I fit still do na to beg for mesi from God wey bi my judge.
Pesin wey feel sey na only en know di korrect tin, na big fool, but pesin wey dey waka with wisdom, go dey save.
My mind dey klear, but dat nor mean sey I dey innocent. Na only God go fit judge mi.
So, even if awa mind kondemn us, wi know sey God big pass awa mind and E know evritin.