Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 9:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 I know sey I nor do any bad tin, but my mout fit kondemn mi. Even doh I dey innocent, my mout go still fit put mi for wahala.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 9:20
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E get one man wey dem dey koll Job, e dey stay for Uz land and e dey do wetin God wont. E dey serve God with klean belle and e nor dey do bad tins.


If I sin, na big wahala Yu dey give mi, but if I do betta tin, Yu nor go gri reward mi. I don taya, na shame and trobol kover mi so.


Yu go forgive and kover my sins. Yu go tie dem put for bag.


Job just dey tok, bikos e nor know wetin e dey tok and all wetin e dey tok, nor make sense.


But Job! No nid for yu to dey tok, bikos e klear sey yu nor know wetin yu dey tok about.”


E get any man wey dey innocent before God? E get anybody wey dey klean before di Pesin wey kreate am?


Even if I nor do any bad tin, di only tin wey I fit still do na to beg for mesi from God wey bi my judge.


“Yes, all dis tins wey yu dey tok so, I don hear dem before. But how pesin go fit take win kase with God?


my trobols go still kom back again; den I go know sey Yu dey hold mi bikos of di bad tins wey I do.


If I dey guilty, wetin go make mi komplain?


If to sey Yu, my God won kount all di sins wey pesin kommit, den na who go fit stand before Yu?


Make Yu nor judge mi yor savant, bikos evribody dey guilty for yor front.


Too mush tok dey make pesin sin, but wise pesin nor dey tok anyhow.


Make doz wey dey tink and tok bad-bad tins nor espect any good tin escept trobol.


I kon sey, “My own don finish, bikos evry word wey dey komot from my mout, na sin full am and I dey stay with pipol wey all dia words na sin and naw, I don use my eyes si Oga God wey bi di king wey get pawa.”


But di man won show sey en know well-well, so e kon ask Jesus, “Who bi my neighbour?”


But Jesus tell dem, “Na una dey make unasef good for pipol eye, but God know una heart. Bikos wetin human being value well-well, naim God nor like.


and wahala, naim e dey kause. Dia mind don spoil and dem nor know di trut again, bikos dem tink sey dem fit use God work take make money.


bikos wi dey make many mistake. If pesin nor dey make mistake for wetin e dey tok, dat mean sey e dey pafet and e go fit kontrol en body.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ