18 E nor let mi breath well; E don kover my life with bitterness.
Abi my life neva finish? Make Yu leave mi with my own! Abeg, make I enjoy di small life wey I still get.
Yu just dey rite bad tins against mi; even di ones wey I kommit wen I bi small pikin.
“As long as God Almighty wey nor gri judge my kase kon make my life bitter dey alive,
“Wetin make God dey give lite to pesin wey dey sofa? Why E dey give life to doz wey dey face trobol?
Nor look mi again, make Yu leave mi alone, so dat I go swallow my own spit.
Make Yu take yor vexnashon from mi, so dat I go fit smile again before I die.
Yor vexnashon dey press mi and yor waves don kover mi.
Instead, dem get strong heart kon dey woship Baal, just as dia grand-grand papa tish dem.
Na bitterness and sofa bi di food and drink wey God dey give mi.
Evritime, na only mi E dey always ponish.
No ponishment dey sweet pesin wen dem dey ponish am, bikos e dey pain. But di pesin wey God ponish, go get life wey nor dey end.
Naomi ansa, “Make una nor koll mi, ‘Naomi’, but make una koll mi ‘Mara’, bikos God wey get pawa don ponish mi well-well.