Wen e pray to God, God hear and ansa en kry for help. God bring am kom back to Jerusalem wey bi en kingdom. Den Manasseh kon know sey na di Oga bi di true God.
As I dey lead dem kom back, dem go dey kry, beg and pray make I forgive dem. I go guide dem pass where wota dey kon take dem pass strait road where dem nor go kick stone fall. I go do am, bikos na mi bi Israel papa and Efraim na my first-born.’ ”