I go kount Egypt and Babilon join di towns wey know mi. I go still kount Filistia and Tyre plus Ethiopia town join dem. All of dem dey sey dem born dem for Jerusalem!
God dey vex for en pipol and E don ready to ponish dem. Mountins go shake and pipol wey die, dem go leave dia dead body for street like dirty. God vexnashon nor go end for der, but E go still ponish dem.
Oga God, make Yu raiz-up kon help us! Save us with yor pawa. Make Yu use yor pawa, just as Yu dey do before. Di monsta wey dem dey koll Rahab wey dey di sea, na Yu kut am to pieces.