Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 9:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Wi nor go fit undastand di great tins wey E dey do and all di wonderful tins wey nobody fit kount.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 9:10
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wi nor fit kom klose to God, bikos en pawa big well-well! E always dey rite and korrect as E dey deal with us.


Wen God tok, e dey bi like tonda and wonderful tins dey happen; tins wey wi nor fit undastand.


Wi nor go fit know di great tins wey E dey do and en wonders nor get end.


Na-im bi di Pesin wey dey do wonderful tins wey dey sopraiz pipol, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.


God dey great! Na only en wi suppose to dey praiz! Nobody fit measure as E big rish.


I go tell evribody about yor raitiousness and evriday, I go always dey tok about di pawa wey Yu take dey save, even doh I nor really fit esplain how e bi.


Make una praiz di Oga wey bi Israel pipol God bikos of di wonderful tins wey E do and na only en fit do dem.


My Oga God! Who bi like Yu among oda gods? Who bi like Yu? Di One wey dey holy, wey dey do mirakles and great tins?


God dey make evritin happen for di rite time. Yet nobody go fit really undastand all di tins wey E don do and E put kweshons for awa mind about wetin don happen before and wetin go still happen.


Who fit know how God big rish? Who fit know how God wisdom and undastandin bi? Who fit esplain why God dey do wetin E dey do!


So, make all di glory bi God own; di Pesin wey dey do pass di tins wey wi go fit ask or tink, thru en pawa wey dey work inside us.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ