But e go happen for one special day and na only Oga God know di day. Normal day and nite go dey and even wen evening rish, lite go still dey shine like day time.
Make una nor laf as una take start small, bikos God dey happy sey di work don start and E dey happy to si di ruler for Zerubabel hand.” (Di seven lamps na God eyes wey dey look di whole world.)
Pesin wey get sometin, dem go gi-am more and wetin e get go kon plenty. But pesin wey nor get anytin, even di small one wey e get, dem go take am from am.
Afta dem don free from sin thru awa Oga God and Savior Jesus Christ and dem kon let sin masta dem again, dia kondishon for di end, go worse pass as e bi before.