All di kings for di kountries wey dey near river go kom down from dia throne. Dem go pul dia crown and fine-fine klot komot body kon sidan for groun dey fear bikos of how dem dey distroy una town.
Di king go kry well-well; di prince nor go get hope again and di pipol go dey shake, bikos dem dey fear. I go ponish una for evritin wey una do and just as una judge oda pipol, na so too I go judge una. Den una go know sey na mi bi God!”
For di same way, make una wey yong put body down for di eldas. Make una nor dey karry body up for each oda, bikos God dey oppoz proud pipol, but E dey favor doz wey dey honbol.