8 Una dey si mi naw with una eyes, but una nor go si mi again. Wen una dey look for mi, I go don go.
But naw wen e don die, why I go dey fast? I go-go where e dey one day, but e nor fit kom meet mi for here again.”
Yu don put big shain for my leg and evriwhere wey I waka go, Yu dey wosh mi.
But if pesin die, na di end bi dat. Dem don die; so where dem dey naw?
Yu dey open eye look dis kind pesin? Yu go gri judge mi so?
Dem go vanish like dream and vishon for nite and pipol nor go si dem again.
Pipol wey si dem before, nor go si dem again. Dia family nor go si dem again
E go sleep as rish man, but wen e wake-up, e nor go si en money again.
If to sey I die dat time, I for dey rest naw;
Yu nor fit just forgive mi my sins? Yu nor fit just sorry for all di bad tins wey I do? I go soon die and wen Yu dey look for mi, I go don go.”
But if dem rut dem komot for dia place, dat place go rijet dem kon sey, ‘I neva si una before!’
Wons heavy breeze blow, di flower dey die komot like sey e nor dey der before.
but wen I look again, I si sey dem don die go! Even doh I look evriwhere weda I go si dem, I nor si dem again!
Wen Yu ponish us for awa sins, Yu dey remove awa pawa like rat wey dey chop pesin food. But each of us, na just breeze wey dey blow pass.