Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 7:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 My days just dey run kwik-kwik like moto; but for di end, I nor get hope.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 7:6
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Even if E kill mi, I go still dey bilive am; I go still tell am wetin dey do mi!


Just as wota dey wosh stone klean and heavy rain dey wosh di san, na so too Yu take distroy awa hope for life.


My years nor plenty again and I go soon go where I nor go fit kom back again.


“My spirit don weak well-well and my life go end just naw. Na grave dey wait mi naw.


My plans don fail; my days go soon end and I nor get hope again.


any hope go still dey for mi? Who dey bilive sey I still get hope?


No, my hope go follow mi wen I dey go where dead body dey? Wi go-go grave togeda?”


E skata mi for evry side, until I nor get hope again.


Wish kind pawa I get to still dey alive? Why I still dey live wen I nor get hope?


“No day good for my life since dem born mi and dem nor dey last.


My life dey pass kwik-kwik like shadow for evening and I dey die go like grass.


Wi just bi like air wey dem dey breath; awa days bi like shadow wey dey fade go.


Na trobol dey distroy wiked pipol, but doz wey dey fear God, go get life afta dem don die.


Israel pipol, make una nor let una shoe skata or allow una troat dry as una dey run follow oda gods. But una sey, “No! Wi nor go fit go back. Wi love dis gods and wi go follow dem.”


Dat time, una dey without di Mezaya and una nor get share for Israel blessings and since una nor get hope and una dey without God for dis world, una kon bi strenja to God kovenant wey E promise Israel pipol.


As sun dey dry grass and flower and dia beauti dey die forever, na so rish pesin go dry, as e dey porshu and love money.


but yu nor know tumoro. Wetin yor life bi like? Yu bi like smoke wey dey kom out from fire. Pipol go si am, den small time e go vanish.


So, make una always dey ready for akshon. Make una shine una eye and put hope for di grace wey Jesus Christ go bring.


Human being bi like grass and wetin make am fine, bi like flower; di grass go dry and di flower go die,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ