God sey, “My Jerusalem; di town wey dey sofa and nor get help; di place wey nor get who go konfort am. I go use stones wey dear well-well take build una foundashon again.
For morning time, una go sey, ‘If to sey na evening wi dey’ and for evening time, una go sey ‘If to sey na morning wi dey!’ Dis na bikos, di kind tins wey una go dey si around una go make una dey fear.