Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 7:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 Yu wey dey wosh us, na wetin I do Yu? Abi I don sin against Yu? Why Yu dey target mi? I bi wahala to Yu?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 7:20
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Na only Yu bi God. Na Yu kreate di heaven and di stars for sky. Yu kreate land, sea and evritin wey dey inside, den kon give dem life. All di pawa for heaven, dey bow woship Yu.


Yu dey look to si weda I go sin, so dat Yu nor go forgive mi.


I go tell God sey, ‘Before Yu kondemn mi, first tell mi wetin I do wey make Yu dey vex.’


Den wetin make Yu dey look for my sins and evry mistake wey I make?


Yu just dey rite bad tins against mi; even di ones wey I kommit wen I bi small pikin.


“Naw, bikos na Yu dey kount my steps, Yu nor go kount my sins again.


No! Na bikos of yor sin and all di oda bad tins wey yu do.


Instead make I chop, I dey kry and my pain dey pour kom out like wota.


Oda pipol dey try to hide dia sin, but I neva ever hide my own.


Di pesin go sing give odas sey, ‘I sin kon do wetin dey bad, but God nor ponish mi as e suppose to bi.’


‘I nor dey guilty; I neva do any bad tin or kommit sin.


Or to ask God sey, ‘Wetin I go gain if I nor sin? Any nid dey to live klean life?’


If yu sin, e nor give God any trobol. Even if yu kontinue to dey sin, e nor go shake am.


God arrow don enter my body and dia poizin dey flow inside my spirit. God don make mi dey fear.


Dem go turn and run from Yu, bikos of yor arrow wey Yu shot.


Yor goodness bi like di highest mountin and di way Yu dey judge, klean like river bottom. Yu protet both pipol and animals.


My Oga wey bi God for Heaven Sojas, na how long Yu go dey vex for awa prayers?


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ