8 “Why God nor gri give mi wetin I ask for? Why E nor ansa my prayer?
as e dey travel go di wildaness. E go sidan under one big tree kon sey make God kill-am. E sey, “My Oga God, my eye don si wetin big pass mi, I beg, make Yu kill mi. I nor even betta pass my papa dem.”
“Life don taya mi; so make Yu hear as I dey tok how my heart betta rish.
Dem dey find deat, but dem nor dey si am; dem dey find am pass wetin dey precious.
Dem dey-dey happy wen dem die go dia grave.
I nor fit tosh dat kind food, bikos e dey make mi sick.
I wish sey God go distroy mi! I wish sey E go just kill mi with en hand.
I taya as I dey wait make Yu save mi, but I don put my hope for yor word.
So my God, make Yu just kill mi. E betta make I die, dan dis life wey I dey live so.”