3 dem go heavy pass san wey dey for sea, bikos dem dey heavy and na dis make knee dey tok like dis.
“Today, my komplain still dey make my heart betta; I nor fit hold my bitterness.
Make God just test mi weda I dey klean and E go si sey I nor do any bad tin.
My Oga God, Yu don do wonderful tins for us. Wetin Yu plan for us too many to kount. Nobody bi like Yu. If I start to kount all di wonderful tins wey Yu don do, I nor go fit kount dem finish.
Yu nor dey let mi sleep and I too dey weak to pray!
Even doh san and stone dey heavy, e nor still heavy rish di wahala wey foolish pesin dey kause.
Una wey don taya and karry heavy load, make una kom meet mi and I go give una rest.