24 “Okay! Make una tish mi; make una tell mi my fault and I go kwayet listin to una.
I go tell God sey, ‘Before Yu kondemn mi, first tell mi wetin I do wey make Yu dey vex.’
Wish kind sin I kommit sef? Wish kind bad tin I do? Wish kind wrong tin Yu sey I do?
I kwayet dey listin to wetin una dey tok since; I dey listin to una wise word and as una dey tink wetin to tok.
“Job, make yu listin and hear evritin wey I won tok!
den tell mi my fault so dat I nor go do dem again?
Job, wi don study dis tin wey dey happen and wi know sey na true. So, hear dis words make yu use am for yor own good.”
Or make una save mi from my enemy pawa and from wiked pipol?’
True word dey pain o-o! But wetin yu dey tok nor make sense.
So God, how I won take know all my fault? Make Yu klean mi from di bad tins wey I do wey I nor know.
God sey, “I go guide and take yu pass di best road for life. I go advise and wosh ova yu.
Wen wise pesin advise pesin wey ready to listin, wetin e tok, betta pass fine gold ring or necklace.
Anytin yu tell wise pesin go make am wise more-more. Anytin yu tell raitious pipol go give dem undastandin.
My brodas and sistas, make una undastand dis tins: Make una dey listin well-well and nor dey kwik tok or vex.
bikos wi dey make many mistake. If pesin nor dey make mistake for wetin e dey tok, dat mean sey e dey pafet and e go fit kontrol en body.