20 but all dia hope die for dry river.
Yu bi oga for lie-lie; yu bi like doctor wey nor fit trit pesin wey dey sick.
“God don make my family far from mi; I don turn strenja to pipol wey know mi.
Like tit wey dey pain pesin or leg wey don break, na so too e bi to trust pesin wey nor dey sirious wen trobol kom.
So, wetin make mi still dey sofa? Why I go dey bear dia curse like sore wey nor get cure? Yu dey plan to leave mi like stream wey dry?”
Na Yu bi di hope wey Israel get; so make Yu disgrace doz wey leave Yu. Make dem disappear like name wey dem rite for san, bikos dem forget Yu wey bi di spring wey dey bring fresh wota.”
Dis hope nor dey disappoint pesin at-all, bikos God pour en love like river wey dey flow inside awa heart, thru di Holy Spirit wey E give us.
God word sey: “Si, for Zion, I dey arrange stones wey go make pipol fall, yet doz wey bilive am, E nor go disappoint dem.”