11 Wish kind pawa I get to still dey alive? Why I still dey live wen I nor get hope?
Abi my life neva finish? Make Yu leave mi with my own! Abeg, make I enjoy di small life wey I still get.
Na ordinary leaf wey breeze dey blow Yu won fight? Abi na dry leaf Yu won porshu?
Naw, I don turn rotin wood and I bi like klot wey worm chop anyhow.
“My spirit don weak well-well and my life go end just naw. Na grave dey wait mi naw.
My only hope na where dead body dey, where I go for go sleep for darkness.
I dey komplain give human being? If I nor dey komplain give human being, wetin go make mi kwayet?
“Si how yu don help pipol wey nor get pawa. Yu don save pipol wey nor get strent at-all!
Na stone dem take make my strent? Abi my body na bronze?
E don take my strent, even doh I still dey alive! E don make my days for di world, short.
“My God, na how long I go dey dis life? Wen I go take die? Make Yu tell mi wen my life go end.
Si! Yu don make my life short well-well and my whole life bi like one sekond to Yu. True-true, evribody life just bi like breeze wey dey blow pass.”