Na seventy years Yu give us! Some pipol even dey rish eight years. Even di estra years wey human being dey live, na pain and trobol full am; but di years go soon disappear and wi go fly go.
All dis tins dey taya pesin and nobody fit shange or tok as dem bi: No matter wetin wi dey si and hear, awa eyes still won si and awa ear still won hear more.
As far as yu dey alive, evritin wey yu dey do, nor dey bring anytin escept pain and trobol and yu nor go even fit rest well for nite. All dis tins dey yuzles!
E nor get anytin wey dey happen to una naw, wey neva happen to odas before, but God dey keep en promise and E nor go allow una pass thru wetin una nor go fit bear.