As dis one still dey tok, anoda savant run kom sey, “Oga! Kaldea pipol form three group kom attack us. Dem karry all di kamel kon kill yor savant dem and na only mi one eskape kom tell yu.”
God ask Satan, “Yu know my pikin wey dem dey koll Job? Nobody bi like am for dis eart; e dey klean and good well-well. E dey do wetin God wont and e nor dey do bad tins. Yu beg mi make I let yu attack am wen e nor do anytin, but e still dey fear mi as before.”
God don make betta promise and E go make am happen with en pawa den E go sey: “Enemies nor go chop una korn again and strenjas nor go drink una wine again.
King Nebukadnezzar for Babilon don skata, chop and distroy my town like empty cup. E swallow am like wiked animal and na awa propaty full en belle. E still porshu us komot from awa own land.
Dem go chop una animals pikin and una plants, den dem go distroy una. Dem nor go leave any korn, new wine, olive oil or animals for una and una go hongry die.
Den God angel kom Ofrah village kon sidan under di oak tree, wey bi Joash wey kom from Abiezer family, own. Den, en pikin Gideon dey hide pick wheat for one wine press, so dat Midian pipol nor go si am.