Wolf and sheep go dey chop togeda; lions go chop grass like melu, while snake go chop san and dem nor go dey wiked again. Nor-tin wey go kause wahala or evil go dey for my holy mountin for Zion again.”
“I go make kovenant wey go guide and protet dem. I go distroy all di wiked animals for di land, so dat my sheep go fit stay for peace as dem dey di field and forest.
Dia tree go bear fruits; dia fields go bear betta plant and evribody go stay for peace for en land. Wen I don break di shain wey dem take tie my pipol kon free dem from pipol wey dey trit dem like slave, den dem go know sey na mi bi God.
My God send en angel kom klose di lion dem mout, so dat dem nor go tosh mi, bikos E si and know sey I nor do anytin. And I neva still do any bad tin to yu, my king.”
For dat time, I go make kovenant with all di wild animals and birds, so dat dem nor go wound my pipol. I go still take di tins wey dem take dey fight war komot from di land kon let my pipol stay for peace.