I go make una pipol and animals dey plenty evriday. Una go many pass as una bi before and una shidren go plenty. I go let una stay here as una dey before kon make una betta pass before. Den una go know sey na mi bi God.
Make yu give dis kommand to rish pipol. Tell dem sey, make dem nor dey karry body up kon dey trust dia money wey nor get value and make dem dey trust God wey dey give us evritin wey wi nid to take enjoy dis life.
Make una tink of how wi dey look pipol wey get patient sey, God don bless dem. Una hear how Job get patient and how God bless am leta. God get mesi and E dey sorry for pesin well-well.