9 Anybody wey si Leviatan go fear fall for groun.
Wen dem don make am vex, e go shaut and nobody go try go stand for en front.
Make yu try go tosh am, den yu nor go ever try am again; bikos yu nor go ever forget di fight!
Wen God dey Judge una, E go karry una go. E go judge di town both for day and nite. Na fear and pain dis message go give una wen una don undastand am.
Strong eartkweke, honga and sickness go dey evriwhere; difren-difren tins and bad signs go dey happen and fear go katch evribody.
All dis tins wey dey happen go make una mad.
God tell Samuel, “Look! I won do sometin for Israel; wen anybody hear am, en two ear go dey shine like star.