30 Di skale wey dey en belle bi like pot wey don break; as e dey waka, e dey leave mark for di mud like sey e won separate di groun.
Spear bi like straw to am and e dey laf wen men dey trow arrow kom meet am.
E dey shake di sea like wota wey dey boil kon make am dey dance like oil for pot.
I go make una bi like new swod wey get sharp korna. Una go distroy all una enemies and di mountins and hills go skata for groun like dust.