24 En heart bi like stone wey nor dey fear anytin; e dey strong well-well like grindin stone.
E nor get any weak part for en skin; e dey strong well-well and e bi like iron wey dem nor fit bend.
Wen e stand, even pipol wey strong well-well, dey fear and di fear dey make dem shake anyhow.
Bikos I know how una sturbon rish; una neck strong like iron and una head bi like bronze.
My God, shebi na trut Yu wont? But even wen Yu ponish dis pipol, dem still nor gri shange and wen Yu nearly distroy dem, dem nor gri take korreshon. Dia heart strong like rock and dem nor won turn from sin kom meet Yu make Yu for forgive dem.
Dia heart strong like rock and dem nor gri obey my profets wey dey among dem. So I vex kon ponish dem well-well.