6 Yu suppose get konfident and hope, bikos yu dey woship and trust God.
“My Oga God, make Yu remember sey I don serve Yu with all my mind and I dey always try to do evritin wey Yu wont make I do.” Den e start to kry well-well.
E get one man wey dem dey koll Job, e dey stay for Uz land and e dey do wetin God wont. E dey serve God with klean belle and e nor dey do bad tins.
Even if E kill mi, I go still dey bilive am; I go still tell am wetin dey do mi!
I dey pray to God from my heart, bikos I know sey I nor do any bad tin.
any hope go still dey for mi? Who dey bilive sey I still get hope?
My God, my hand klean and I trust Yu with all my heart, so make Yu show sey I dey innocent.
Even doh strong sojas gada round mi, my heart nor go fear. Even if dem attack mi, I don go shek at-all.
Doz wey dey fear God, dey save and God dey guide dia shidren.
God go save yu and E nor go let trap katch yu.
Na-im dey make en pipol strong kon make dem dey save. E dey protet and give dem wisdom and na only doz wey dey fear am, E dey do all dis tins for.
So, make una always dey ready for akshon. Make una shine una eye and put hope for di grace wey Jesus Christ go bring.
Since una dey koll God wey dey judge evribody akordin to wetin e do, “Papa”, make una live una life with respet for am.