18 If God nor even bilive en savants wey dey heaven; dey si komplain for en angels body,
Anybody fit tish God, abi who dey judge doz wey dey heaven?
Anybody fit dey klean before God? How yu wey woman born won take dey pure?
Breeze na yor messenja and fire na yor savant.
God nor sorry for di angels wey sin, E trow dem for hell and tie dem for darkness until di day wen E go judge di world.
And I still dey remind una about di angels wey nor stay for where God put dem, but kon komot for where dem suppose dey. God don shain dem tie for darkness until wen E go judge di world.