Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 4:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 E get any man wey dey innocent before God? E get anybody wey dey klean before di Pesin wey kreate am?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 4:17
25 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I know sey Yu nor go do dat kind tin. Yu nor go kill pipol wey dey good with di bad ones.”


No klean tin fit kom from wetin nor klean like human being.


Any human being fit dey klean? Anybody fit dey rite before God?


Anybody fit dey klean before God? How yu wey woman born won take dey pure?


Na di same God wey kreate mi, kreate my savants too.


I nor sabi praiz pesin anyhow, bikos God go ponish mi, if I do like dat.


But dem nor dey kry to God wey kreate dem; wey dey give dem hope for darkness.


“Job, e dey rite make yu dey sey yu nor do any bad tin for God eye?


I go use wetin I know take show sey God dey rite. I go tok di ones wey I know.


Sometin stand for der and even wen I look, I nor fit si wetin e bi.


Yu dey try to sey I dey wiked, bikos yu dey sey I dey wrong and yu dey rite?


Abi God nor dey like justice? Abi God nor dey do wetin dey rite?


“Yes, all dis tins wey yu dey tok so, I don hear dem before. But how pesin go fit take win kase with God?


Make Yu nor judge mi yor savant, bikos evribody dey guilty for yor front.


God dey rite for evritin wey E dey do; na goodness full en body.


bikos e nor get anybody for dis world wey dey good well-well and nor dey sin.


My God, Yu dey always trit mi well anytime wey I komplain give Yu. But I ask Yu one kweshon about good judgement: “Why e bi sey wiked pipol dey prosper and pipol wey nor dey honest, dey susid?


Na wikedness full human being mind and e bad well-well. Na who go fit undastand am?


Who fit know how God big rish? Who fit know how God wisdom and undastandin bi? Who fit esplain why God dey do wetin E dey do!


But una sturbones and strong heart nor let una turn from sin kom meet God, so una dey make una ponishment many more-more, for di Day wen God go judge di world, bikos en na judge wey nor dey support bad tins.


But, my friend, I dey ask, “Who yu tink sey yu bi, wey make yu dey ask God kweshon? Pot wey dem mold fit ask di pesin wey dey mold am sey, ‘Why yu dey mold mi like dis?’ ”


Each for di for creatures get six feada and eye full di feadas. Dem nor dey ever rest for nite or day and dem dey always sey: Holy! Holy! Holy! Na-im bi di God wey dey mighty. Di Pesin wey dey since, wey dey naw and wey go soon kom.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ