13 E kom tell mi like sey na dream for nite wen evribody dey sleep.
Wen nite rish, Abram kon sleep deep sleep, den fear kon dey katch am.
So Oga God kon make man sleep deep sleep and as e dey sleep, God take one from di man rib kon use flesh kover di place.
But for dat nite, God kon appear to Abimelek for dream sey, “Na die yu won die so, bikos di woman wey yu take so, na somebody wife.”
and e kon dream. E si one strait road wey from eart go rish heaven and God angels dey waka up-and-down for di road,
But God kom meet Laban for dream for nite kon tell am, “Make yu mind wetin yu go tell Jakob, weda e dey good or bad.”
Wen Israel dey sleep for nite, God kon tok to am for vishon sey, “Jakob, Jakob!” E ansa, “Na mi bi dis!”
I fear and all my body kon dey shake.
But I hear as e dey tok and wen I hear dis vois, I just fall face groun.
For nite, God show and tell Daniel evritin thru dream. Den Daniel praiz God wey dey heaven
But I dream one bad dream wey make mi fear. Wetin I dey tink as I sleep for my bed and di vishon for my mind really make mi fear well-well.
As e dey tok to mi, I kon faint for groun. But e tosh mi and I get up.
God tell dem, “Make una listin to mi: “If anybody bi profet among una, mi God go show mysef to am thru vishon kon tok with am for dream.