Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 39:27 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

27 Abi eagle go wait for yor kommand before e go build en nest for mountin?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 39:27
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Hawk dey kom ask yu make yu tish am wisdom, so dat e go know how to fly wen e spread en feada face sout?


E build en house for di rock wey high pass kon use rock take do pillow for nite.


E satisfy awa life with good tins and even as wi still dey yong, awa life strong like eagle own.


‘Una don si wetin I do Egypt pipol. Una si as I take karry una for eagle feada kon bring una kom meet mi.


bikos yor money fit finish wons like sey e get feada kon fly leave yu like eagle.


“ ‘How eagle take dey fly high-high for sky? How snake take dey waka for rock? How ship take dey move for river and how man take dey love woman?’


But pipol wey dey wait for God to kom help dem go get new strent and pawa. Dem go fly high like eagle; even wen dem run, dem nor go taya and wen dem waka, dem nor go faint.


Una pride don deceive una. Nobody dey fear una as una tink. Una dey stay for rock and on-top mountin a nd even doh una house high like eagle own, God go bring una kom down.” Dis na wetin Oga God tok.


“Blow di trumpet! Enemies dey rush dey kom attack my pipol like eagle! My pipol don break di kovenant wey I make with dem kon go against my laws.


“ ‘Dis na di bird wey una nor suppose chop. Make una nor ever chop any kind vulture,


But even if una fly like eagle or build una house among di stars, I go bring una kom down!” Na so mi, God, tok.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ