I don listin to dem well-well, but dem nor dey tok trut. Nobody among dem dey feel bad for di bad tins wey dem do; no one among dem ask sey, ‘Wetin bi di bad tin wey I do?’ Instead, all of dem just dey do wetin dem wont like sey dem bi horse wey dey rush go fight.
God sey, “Make wise pipol nor dey boast, bikos dem wise and make doz wey strong, nor boast sey dem get pawa. Make doz wey get money, nor boast with di money wey dem get.