17 Na mi make am nor get sense like dat! Na mi nor gi-am wisdom.
Wen Babilon ofisas send pipol go find out about di sign wey happen for di land, God kon leave di king alone, so dat E go fit test am, make E for know wetin dey en mind.
Yu don klose dia mind, dem nor go fit undastand anytin, but make Yu nor let dem win mi.
Dem nor dey turn to God wey make us get sense; di One wey make us wise pass animals and birds.
E dey bihave like sey nor bi en get di egg and e nor koncern am if di egg break or skata.
But wen e don start to run, e dey laf horse and di pesin wey dey ride am.
I bin dey vex for dem bikos of dia sin and long-trot, so I kon ponish and abandon dem bikos dem sturbon and dey do as dem like.
But King Sihon for Heshbon nor gri, bikos na so God wont make e bi, so dat E go fit give di land to us today.
bikos evry betta and pafet gift dey kom from God. E dey kom down from di Papa wey kreate lite and E nor dey shange.