34 Yu fit kommand di kloud kon sey make rain bigin fall?
Yu nor dey si again, bikos di trobol don too dark for yor eye and wota don kover yu.
Who fit kount di kloud, bikos e feel sey e wise kon tell dem sey make rain fall;
But e get one Pesin wey make di stars, Pleiades and Orion. E turn darkness to lite kon turn day to nite. E koll wota from sea kon pour am put for di eart. En name na God.
Make una ask God for rain wen rainin sizin rish, bikos na God dey give rain wey dey make evritin wey pipol plant, grow.
Den e pray again and di sky kon bring rain and evritin wey dem plant, kon grow.
So Samuel koll God and God kon make tonda and rain fall thru-out dat day. All di pipol kon dey fear God and Samuel.