25 Who dig pit for di rain wey dey fall kon klear road for tonda nois?
Na God dey choose where di rain go fall rish and where tonda go travel pass.
Yu don rish di place where sun from dey kom or di place wey east wind for dey blow kom?
Who make di rain dey fall for where nobody dey stay?
E dey make kloud raiz kom from where di eart for end. Na en dey bring tonda kom wons rain dey fall and bring breeze kom out from where dem dey.