24 Yu don rish di place where sun from dey kom or di place wey east wind for dey blow kom?
E kreate di sky wen E separate di wota and divide lite from darkness.
I keep dem dey wait di time wen trobol go kom and di day wen war go start.
Who dig pit for di rain wey dey fall kon klear road for tonda nois?
So Moses stresh en hand face di sea and God kon divide di sea with strong breeze for nite, den di wota turn to dry land.
Wen sun start to shine, God kon send one hot breeze kom from east. Di sun dey shine for Jonah head and e nearly faint. So as Jonah dey vex, bikos di plant wey kover en head don die, e kon sey, “E betta make I die, dan dis life wey I dey live so.”
Just as tonda lite dey kom from east go west, na so e go bi wen Man Pikin go kom.