23 I keep dem dey wait di time wen trobol go kom and di day wen war go start.
Pipol wey nor know God go just dey vex and even wen E ponish dem, dem nor go sey make E sorry for dem.
Dis na how E dey feed and provide plenty food for pipol to chop.
Yu don ever go where I dey keep di snow and di ice-blok rain, put?
Yu don rish di place where sun from dey kom or di place wey east wind for dey blow kom?
So, by dis time tumoro, I go make strong ice-blok rain wey dem dey koll ‘hail’, fall as e neva fall for Egypt before.
Fire wey mix with ice-blok kon dey fall too. Di rain strong well-well and Egypt pipol neva ever si dis kind rain before.
God go shaut well-well kon fight with pawa. Yes! E go vex kom with fire wey dey distroy, heavy rain and with big-big stone wey dey fall from heaven.
Wen rain fall, wota kon full di groun, den strong breeze kon blow di house, na wons e go fall skata for groun.”
As dem dey run from Israel pipol go di low groun for Bet-Horon, God kon make big-big stone dey fall from sky for dia head go rish Azeka. Dem die well-well and di ones wey di stone kill, many pass doz wey Israel sojas kill.
Ice-blok wey heavy rish hundred pounds kon dey fall from heaven on-top pipol, but dem still dey curse God, bikos of dia sofa.