18 Yu know how di world big rish? Ansa mi, if yu know!
bikos E dey si di end for di eart and E dey si evritin wey dey under di sky.
Yu know where di lite from dey kom or wetin dey bring darkness out?
Yu measure where di eart go rish kon make both dry and rainin sizin.
Una nor know? Una neva hear? God go dey forever. Na-im kreate di whole world. E nor dey taya or weak. Nobody fit undastand wetin E dey tink.
Dis na wetin Oga God tok: “Just as nobody go fit measure di heavens or open di eart foundashon, na so too I nor go ever rijet Israel pipol bikos of wetin dem do. Mi, wey bi God, don tok!”
Dem go waka round di world and where God pipol dey stay and di town wey evribody love, fire go kom down from heaven kon burn am finish.