17 Anybody don ever show yu di gate wey dey guide where dead body dey?
I go soon go di land where Yu nor go fit si mi and I nor go kom back again.
God high pass di heavens; so wetin yu go fit do? E deep pass where dead body der; so wetin yu feel sey yu know?
E open all di sekret tins wey dem hide for darkness kon put lite for where deep pass.
Where dead body dey stay just dey open before God; nor-tin fit kover am from en eye.
Make darkness and deat shadow kover am! Make betta kloud dey on-top am; make darkness kover en lite.
E nor get as di darkness tick rish, e nor fit hide sinnas from God.
Some sidan for where dark pass and dem shain dem with iron,
E komot dem from di darkness kon break di shains.
Dem nor even fit chop and na die remain for dem to die.
bikos deat kover mi like klot and di fear to die go grave, dey make mi shake. Na only sorrow and trobol I dey si.
Even doh I waka pass di place wey dark pass and where deat dey, I nor go fear anytin, bikos E dey with mi; en rod and staff dey protet and konfort mi.
My Oga God, make Yu sorry for mi. Si as my enemies dey trobol mi, so make Yu kom take mi komot from deat mout.
But e get one Pesin wey make di stars, Pleiades and Orion. E turn darkness to lite kon turn day to nite. E koll wota from sea kon pour am put for di eart. En name na God.
una wey dey darkness, don si big lite and una wey don nearly die, don get life.”
di One wey dey alive! I die before, but naw, I dey alive forever and ever. Deat and grave key dey my hand.