Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Job 37:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Wen God tok, e dey bi like tonda and wonderful tins dey happen; tins wey wi nor fit undastand.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Job 37:5
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Yu fit find out where God from kom? Or how E take dey get en mighty and strong pawa?


But all dis na small tin kompare to di pawa wey E get. Na small wi don hear. Who go fit really undastand how God strong and great rish?”


“Wi nor fit know how God strong rish. Wi nor fit search or kount how many years God don dey.


Job, make yu wait small kon listin; konsida all di wonderful tins wey God don do,


Yu know how di kloud take hang for sky? Dat na one tin wey God do wey dey sopraiz evribody.


Make all of una listin to God vois. Make una listin to di tonda wey dey kom out from en mout.


Dat time, una go hear di vois well-well kon si di brite tonda lite as e dey pass.


Yu strong rish mi? Abi yor vois loud rish my own?


Wi nor go fit know di great tins wey E dey do and en wonders nor get end.


Wi nor go fit undastand di great tins wey E dey do and all di wonderful tins wey nobody fit kount.


E shot en arrow kon skata en enemies and as en lite flash, dem kon dey konfuse more-more.


God vois dey sound on-top di sea and en vois bi like tonda, bikos na en bi di God wey dey kause tonda on-top strong sea.


God dey make evritin happen for di rite time. Yet nobody go fit really undastand all di tins wey E don do and E put kweshons for awa mind about wetin don happen before and wetin go still happen.


Una nor know? Una neva hear? God go dey forever. Na-im kreate di whole world. E nor dey taya or weak. Nobody fit undastand wetin E dey tink.


Who fit know how God big rish? Who fit know how God wisdom and undastandin bi? Who fit esplain why God dey do wetin E dey do!


Dem dey sing Moses wey bi God savant and di Lamb song sey: “God wey dey mighty, si as di tins wey yu dey do dey big and wonderful! Yu wey bi king for all nashons. Yu nor dey do parsha and evritin wey yu dey do, na true.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ