3 Na-im send lite go cross di sky; from one end go rish di oda end for di world.
bikos E dey si di end for di eart and E dey si evritin wey dey under di sky.
Na God dey choose where di rain go fall rish and where tonda go travel pass.
E load di kloud with wota and lite dey flash kom out
as di kloud dey go where God sey make e go. Di kloud dey do evritin wey God kommand for dis world.
Dat time, una go hear di vois well-well kon si di brite tonda lite as e dey pass.
Abi yu don kommand day make e seize di eart kon shake wiked pipol komot from where dem hide put?
If yu kommand lite make e flash, e go ansa yu sey, ‘I go do evritin wey yu tok?’
My God, yor ways dey holy. E get any god wey get pawa like Yu?
En tonda lite dey shine round di eart, so wen di eart si am, e kon dey shake.
God go raiz flag as sign for di pipol; E go gada dem togeda again with all en pipol wey skata for evriwhere for di eart.
Just as tonda lite dey kom from east go west, na so e go bi wen Man Pikin go kom.
Den for heaven, God Temple kon open and en Kovenant Box dey inside di temple. Tonda kon dey make nois and spark, den strong eartkweke happen and big-big ice-blok kon dey fall.