God na king and en glory wey dey shine well-well, kover evriwhere. True-true, God don kover ensef with glory, strent and pawa. Di world stand gidigba and nor-tin fit shake am.
Di king dey strong; E love to judge well. God dey make sure sey dem judge evry kase well. Na Yu make betta judgement and raitiousness dey for Israel land.
God dey make evritin happen for di rite time. Yet nobody go fit really undastand all di tins wey E don do and E put kweshons for awa mind about wetin don happen before and wetin go still happen.
So make una kom tok una kase; make una judge for unasef! Who don fit tok sometin and e happen? Nor bi mi bi God wey dey save pipol? No oda god dey apart from mi wey bi God and wey dey save una.
Tell dem sey, ‘God sey, “As long as mi wey get pawa dey alive, I nor dey happy to si doz wey dey sin, dey die. I prefer make dem stop to sin, so dat dem go get life wey nor dey end. So, Israel pipol, make una stop di wiked tins wey una dey do. Na wetin make una won kill unasef finish?” ’
“My Papa don give mi evritin. Nobody know who di pikin bi escept di Papa and nobody know who di Papa bi escept di pikin and pipol wey di pikin choose to show.”
Dis God nor fit die and E dey stay for lite wey nobody fit waka near. Lite wey human being neva fit si. Make all honor and pawa bi en own forever and ever. Amen!